Naija housemates, Chris and Ola, don comot for the ongoing Big Brother Show wey dey shelle as we dey talk so. Ola yarn Big Brother say after im don rapour with the Big Brother House Doctor, im go like use im mind comot from the Big Brother House. Ola yarn say im don reason the matter wella bicos say im no well and the melicine wey im dey take for the house no dey work well for im bodi. Im say im go like go see another doctor outside the Big Brother House so dat dem go fit do better checkup for im bodi bifor im come go kpai bicos say im want win oyibo money.
The bad thing now be say if one housmate from any country dey waka, im partner go must to follow am kia kia. Nobody dey happy say Chris dey comot with im partner sha but na the rules wey dem put down for the game be dat. My advice be say make Ola no reason the money too much oh bicos na who dey life dey find money.
Lagos people dey fear sha no be small. Dis early mon mon naim one trailer wey carry chemical cylinder catch fire and the thing shoot like say na banga naim blast. You need to see the way people dey run like say BH don enter last last.lol.
The place wen the thing for happun no too far from Abraham Adesanya Housing Estate for Lekki-Epe Expressway.
The driver wey dey paddle the lorry by the time wey the thing happun so get luck wella as nothing do am but hand meet im motor boy wey dem assist am wella as the motor boy roast wella. The fire burn the guy so tey people no fit eveb fit know weda na human being im be sef.
The new episode for The Big Friday Show wey dey shelle for MTV Base Block for Silverbird Television don host all the Mavin Records all stars; Don Jazzy, Dr. Sid, Tiwa Savage, D’Prince and Wande Coal.
Na today Friday 18th by 6pm for Silverbird television naim dem go show am and if you get DSTV for house, na Channel 131 naim dem dey show am for there and na the same time. Make una try watch am make we see wetin dem get to offer to us with this there new group.
The police service commission don ready to torchlight the 6 people wey kpai for Akwa Ibom. The three brothers of film maker and founder for Liberty Foundation Group Ministries, Evangelist Helen Ukpabio join the people wey the badosky dem delete. The commission don yarn say dem go make sure say dem torchlight the matter wella make dem know wetin really cause the gbege wey many people take die for the katakata.
Helen Ukpabio sister also kpai some days after badosky delete im brothers. Elizabeth Ukpabio kpai after dem tell am say na three of im brothers naim badosky delete. Their mama wen dey there wen dem delete three of im pikin dey very sick now bicos she never still believe say na true true the thing be cos the thing still be like film for her eye. God help us for naija our country.
Kanye W and Kim K attend one ogbonge party for London yesterday. See as two of dem look take away for the picture wey dem snap. Na una dey top chat now. make una carry go.
Na heavy knockout naim blow yesterday early mon mon for PH. River State gofnor yarn say na arm robber naim cos the knockout wey blow. Wen the badosky dem dey go rob with their guns and knockout wey dem carry for inside the bus, dem dey smoke igbo for inside the bus wey dem dey take dey go do the operation and as we know say baba God no dey sleep, the knockout come blast one time and na only the driver for the bus naim kpai bifor Olopa dem come arrest the other three badosky dem bifor dem run.
“The Queen of Disco,” kpai dis early mon mon for her house for Florida after she don struggle tire with cancer til she come finally kpai for 63 years.
Na five times naim Donna Summer win Grammy Award and na she be the first artiste wey win straight three back to back No. 1 double album.
She stil get husband Bruce Sudano and dem get two pikin together wey be girls, Brooklyn and Amanda. She get one girl pikin too for another man bifor bifor. May her soul rest in peace. amen
26years old pikin of Kenya Finance Minister,Njeru Githae don use im hand delete imsef, The small pikin be student for University of Nairobi bifor im delete and we hear say na for im family house for Runda Estate, Nairobi naim im for kpai im imsef yesterday. The olop for there don already dey torchlight wetin make the pikin kpai imsef.
Damiete naim be the 1st runner up for dis 2012 Most Beautiful Girl in Nigeria peagant wen just finish. Na dis fine babe naim go represent Naija for the Miss Universe Peagant wey go shelle later for dis year so.r
Super Eagles Striker, Osaze Odemwigie don make up im mind say im don ready to say I DO to im woman. The Naija Russian born footballer say im go marry im British babe, Sarah Michael on the 2nd of June for Manchester, UK.