(Singing) We don come again o, we don come again – mama Felicia wayo wayo wayo!

I salute una o! Na me be this una brother wen go awol since. Many things plenty for this naija wey we dey, the more you look the more fresh air dey turn latrine air, but make I leave matter first because my people say na good leg dem dey put for front of king house. Many of una nor know my tory or how me and my ogbonge friend, Zazu Katelmega of Congo Brazzaville take meet and become friend and I come house Zazu for Lagos after KAI demolish im yard. But Zazu na correct guy, nor do nor do im go get job for Abuja begin work for some big boys and from there im come enter politics and come follow our ex-presido for all im journey enter Saudi Arabia. Na so I see Zazu reach, im don enter another levels and im come forget me for jungle for a long time.

But man nor die man nor rotten, na so we begin push am for Lagos. When election come, na so I hear Zazu voice again, as im dey use campaign for fresh air bend INEC neck go one corner. Im fly come my polling booth, yarn with me say if I nor vote Umblerra, say na rain and sun go beat me tire. Na so I carry my finger, piara! Anyway that na another matter nor be everything wey hunter see for bush e dey tell im wife for house. Zazu tell me say no shaking say when yam wey im dey cook done and im pound the yam, say me must to follow am chop. Na so I believe am o dey suegbe for Lagos since April wey we help Zazu deliver all the deliverable constituencies as im want, but immediately dem just announce say na Zazu side win election hands down, Zazu disappearance into thin air like juju powder. The next thing wey I hear be say, Zazu dey vex say why presido nor change the name of Eagle Square to Parrot Square, as per say im Zazu na parrot and na im deliver the election. I come holla Zazu, I say haba, dem never fight you don dey bleed for nose, relax na. This new fresh air presido na for the whole country na, let am do work na. Nor be to begin change name of square wey e nor even safe anymore be the matter now. Na so Zazu vex for me, say me nor dey ever understand say im don tire for me. Say im be wan give me Special Adviser position, but e be like say im nor go pursue the matter again. I say ok o, the one wey God reserve for me nor go pass me, na so I drink my Ijebu garri with kulikuli and nack Alomo bitters join am come go sleep.

One early morning like that, na so somebody begin knock for my door loudly like  Boko Haram workshop, na so I hold Bible for one hand and chaplet for the other hand begin dey bind and cast into lake of fire whoever dey knock for my door.

Who be that? I holler!

“Na me Zazu Katelmega, one and only super special adviser (SSA) to the one and only small-boy-shoeless presido. Open door, we come small meeting for Eko Hotel na im I say make I quick quick see you because e don tay.”

 

“Zazu, I nor sure say na you, because as far as I dey concern for this Lagos, you don go back to Congo wey your forefathers come from.”

 

“My chairman abeg nor vex, open the door for me. Things been get as be, Boko Haram today, MEND tomorrow, Niger Delta the next day – country rough and Abuja don be like Faluja abi na wetin dem dey call that place sef for Iraq sef.”

 

Anyway na so I open door for Zazu. If you see wetin this my old hungry friend deck put for body and the scent wey follow am, you go understand say government money na Sosorobia. Kai, I begin weep for inside my belle. This na parrot wey I dey grind groundnut for, na im dey talk of dollars and pounds for my face.

Anyway, im say im get one kain runs for me and im and some other ogbonge people, from London to America to Jungle City. Say im don serve both dead and living presidos and since im wan begin work for im Six-year term agenda, say im want position imself for internet well well. I come tell am say, well if you want make we do anything for you, our hands suppose clean o and we nor suppose get skeleton for wardrobe. Na so Zazu para for me, kinikan kinikan, me I think say im na murderer abi im na willywilly wey go get skeleton. Anyway sha I come cool am down say wetin im want. Im say im wan begin give naija people, African people and the whole world  gist for pidgin. And im want website wey every-every na pidgin. My brothers and sisters and congregation, na so we see ourselves for this place wey im name Zazugist o. So I don move comot from my old neigbourhood to join Zazu my friend build we country with pidgin o. Make una pray for us o.

Did you like this? Share it: