Naija writer and blogger, Teju Cole don hammer big time for this year Hemingway Foundation/PEN Award for im first fiction book wey im write.
PEN wen dey New England, naim be the regional branch for International writer’s organization and di Hemingway Foundation, na dem announce am on Tuesday say 36 years old Teju cole, naim win the $10,000 for im book ‘Open City.’
Cole story wen yarn about one Naija doctor physical and spiritual journey na also finalist for National Book Critics award. The author so, na Naija im grow am but na New York City im base now.
Na widow of Noble laureate, Mary Hemingway naim found dis Hemingway award for 1976. People wen don win the Hemingway award bifor include Marilynne Robinson and Edward P.Jones.
According to Teju cole website, tejucole.com, im yarn say im na writer, art historian, street photographer and Distinguished Writter in Residence for Bard College.
E yarn say na US dem for born am (1975) to Naija Parents but na for Naija naim im for grow. Na Brooklyn im dey now and naim be author of two books, Every Day is for the Thief, and a novel, Open City (wen im take win dis PEN/Hemingway Award and dem also shortlist am for the National Book Critics Circle Award) |